Saturday, 14 November 2015

SHILOH 2015: Tagged: FROM GLORY TO GLORY


jConductor -- Berger! Mowe! Ibafo! Ogun! Abekuta! Winners Shooooosh!
Enter with your change ooo to avoid
disagree ooo
Bus on the move......!!

Drug seller stands up ...

How Una dey ooo my fellow Nigerians ...
I don come again oo, your famous drug seller...if you're used to this bus you go know me wella!!

This time we don go shange colour.. U see dis one wey we just bring kom so, e fit cure your physical illness,Spiritual illness, Mental illness, Financial illness, Marital illness, and even academical illness..

But wetin dey be say, U see this correct and confied medicine wey we wan use give you so, na only one week you go take use am.. Non stop!

Passengers: Ehn! Ehn... Dis one strong oooo

Drug seller: Yes keh, I tell yo say we don shange colour! (laffs) Un a don ready to hear the name of the drug?

Passangers: Yes oooo..

Drug seller: The name nah FROM GLORY TO GLORY...
This medicine too big you no fit finish am...

D days wey u go use am Na from Tuesday 8th - Saturday 12th Dec 2015...

I go advise you make you come straight to our company so aba boys no go
sell fake give you.

Our company dey Faith Tabernacle Canaanland Ota .
E no far at all oh.

Passenger- how much be your medicine

Seller -- (laughs) Just come with your faith
and believe because the Tested and Trusted
medicine na free of charge oooo...
Nor come alone oh bring your family,friends even ur enemies dem because spiritual food go plenty full everywhere , Miracles no go stop, Signs and Wonder go dey flow like water and you sef go collect your own for free.
Jesus na Baba...

#Shillo2015‬
‪#FromGloryToGlory
‪#TellaFriend. BIGSUNNEL

Contact us:-
07062355279 whatsapp
BBM: 27934951
BBM CHANNEL: C002C5652
Visit www.jameslinktech.blogspot.com.ng
© 2015 JamesLink-Technology Inc. ® NG

No comments:

Post a Comment